E get one particular
restaurant wey i tke dey
chop 4 G.R.A.
E get one oyibo wey dey
always come chop there
too...
Any time dis oyibo chop
finish he go shout '' Hey''! so
I wonder wetin dey make
am shout, i decide to chop
wetin d oyibo dey always
chop so maybe me self go
shout too.. when i reach d
restaurant last week friday, i
order wetin d man dey
chop..
Dem tell me say na chicken
& red wine, so i chop am,
but i no shout, i colet xtra
plate, but i stil no shout.. na
then i just
vex ask 4 my bill. D waiter
tell me say one plate of
chicken & red
wine na N75,000 then d
xtra plate na another
N75,000....
na then i shout hey hey hey
hey,I still dey shout till
now......