Bros H how far na? My country people dey hail you oooo! I know say wherever you dey now belle don dey sweet you because time to show your talent don reach, but Bros as
I dey write you this letter I dey on my knees, I take god of
asuu take beg you, let by gone be by gone, abeg I know
say we don offend u but please forgive and forget!
Lastweek I see oga rain as im dey pack im load sake of say im wan go on holiday, naim I ask am say hw bros H
na, d way d guy reply me I knw say wahala dey! Our lips
are in trouble, naso e go just dey tear anyhow, if we do mistake baff cold water naso we go dey shake like nokia 3310 on vibration, we no go fit knw
which one be public bus or private car again becuz dust
don finish their body! Girls no nid to use brown powder
again na to just stand for outside make dust cover them!
No matter d cream we rub even if we rub 6 gallon of
palmoil our skin go stil dry like envelope
wey dem take send letter bomb to dele giwa
Bros na beg we dey beg, postpone your visit till nextyear!
Bros na we we ooo thanks!
Your faithfully
Victim of harmatatiaisis
Broadcast till it gets to bros harmattan.
One word for Akpos