Earlyface

News => General => Lyrics | Poems | Text Messages (SMS) => Topic started by: smith95 on January 10, 2019, 06:29:36 pm


Title: Unnamed 720x720.jpg LYRICS Lyrics: 2Baba, Simi, Pasuma, Falz X Mr P X Slimcase & Others – “No Shishi
Post by: smith95 on January 10, 2019, 06:29:36 pm
[Slimcase]
My people look here, face me like facebook
Una go see Lizard, Una go say na chameleon

[Falz]
Time don come for us to wake up

[2baba]
My people this na time for action
No more, No More talk talk
We no want yeye leaders, we don tire
The situation e don dey Shuku Shuku

[Simi]
Dem say, the way you lay your bed na so you go lie on top
When you sell your vote na poverty you dey invite oo
Make you shine your eyes

[Chorus]
Make you no sell your vote o
No Shishi 4 bride
If you talk say and I talk say
No Shishi 4 bribe o
If you talk and I talk and we all dey talk
No Shishi 4 bribe
We say, No Shisi 4 bribe
We Say, No Shishi 4 bribe o
We say, No shishi 4 bribe o

[Timi Dakolo]
If you sell, your vote
You sell your opportunity, You sell your tomorrow

[Waje]
You say good roads, good health and education

[Mr P (P’square)]
Yo P, Sing
Them say, the way you lay your bed na so you go lie on top

[Pasuma]
Dem go try to bribe you with Shisi
Make you no sell your future for Shishi
Dem go surely take out the profit na you go suffer
Naija, Amen
Monkey go dey work, Amen
Baboon go dey chop, Amen
Shey na so we go dey

[Chorus]
Make you no sell your vote o
No Shishi 4 bride
If you I do my part and you do your part oo
No Shishi 4 bribe o
Make we play our part and we build this land
No Shishi 4 bribe
We say, No shishi 4 bribe
We say, No shishi 4 bribe o
Nigeria go better

[Illblizz]
Corruption Kill us, Bribery finish us
Last Last chukwu still got us
Who wan change Nigeria, but us
Let’s make it work again, Everybody rise again
Tire for the talk talk, No body wan do the work
Nobody wan die here, i speak with no fear
Change am for them you can’t buy my soul
No shishi for your vote, this na the new oath
How much is your vote really really worth
How much they dem wan give you for the game
If we choose wrong then wetin we gain
My brother wetin we gain

[Falz]
My brother no go sell your future
To some people wey be criminals, wey no get conscience
No be say we go just dey the form vex
And still allow nonsense for another four years
Cos my people still dey jobless
Everyday my people still dey die in hundreds
So make we shine our eyes
Cos no be only two bad choices wey dey the contest
Give me one more verse please

I’m talking to you precisely
You dey school, office or dey do NYSC
With your PVC you can vote wisely
Even when the offer dey bringing is so spicy

[Chorus]
No Shishi 4 bride
If You talk say and I talk say
No Shishi 4 bribe o
Make we play our part and we build this land
We say, No shishi 4 bribe
We say, No shishi 4 bribe o
Nigeria go better
No Shishi 4 bribe
If I do my part and you do your part
No Shishi 4 bribe
You talk and you talk and we all dey talk the same
We say, No shishi 4 bribe
We say, No shishi 4 bribe o

[Slimcase]
Don’t Sell Your Vote! Don’t Sell Your Vote!
Mixing Zeeno foster